
Saturday, September 26, 2015
BABAH OROR SP WAN SURPRISE THE FULL WORLD TOMORROW...NO GAWK AM!
As e be like say this long weekend groove never stop. Babah Oror Sp don ready to shock, sorry na Surprise he wan surprise everybody for Ibadan town tomorrow with him show wey he call Surprise and na for Damilare Garden wey dey beside National Open University for Ijokodo he wan do the level. No be only Woli Babah Oror go dey o, Aunty Yetunde Are go follow dey, Prince Goke Bajowa go dey, Ayo Ajewole Woli Agba for Alfa Sule go dey, Jawale go dey there, St joseph from ph go dey there and yeske me sef go follow dey, your personal persin Afouda Baba Agbalagba. Time na 2pm and dem no go collect gate fee...Lobatan! Abeg come chop the life of your head.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment