Tuesday, September 8, 2015

OLISEH SAY MAKE UNA RELAX O COS HIM NO BE PROFESSOR PELA WEY DEY DO MAGIC


I don taya for pipu wey go enter office finish come dey say dem no be magician o. After we go play draw for Tanzania, we coach for Super eagles, Sunday Oliseh don say make we go relax well well o cos no be him spoil our own for Naija football.

Oliseh say him just dey build ni o, say we sha no go last nation’s cup. He say him believe say dis eagles wey we get now no go be like dem bros, dem suppose fly. But make we go swallow patience o cos no be one day soup wey sweet dey done.

No comments: