The House of Representatives don swear say dem go send one powerfull Committee wey go chuk nose plus eye ontop the recent attack on the Oke – Ako Community inside Ekiti State by Fulani herdsmen. For one motion wey Rep Emmanuel Agboola sponsor, he yan say the number of pipu wey dey port go heaven sake of say the attack of Fulani no be sheyrey kam biaoo plus say e fit cause anoda attack from the Ekiti pipu ontop the Fulani if dem no chuk hand for the mata. The lawmakers dem don direct the Inspector – General of Police, Solomon Arase say make send police to area wey the yawa gas plus say make the National Emergency Management Agency (NEMA) send relief materials to the affected community. The Committee go send report back to the House within six weeks so dem go fit sabi wetin dem go do ontop the mata.

No comments:
Post a Comment