
Tuesday, September 22, 2015
NA WA O...DEM SAY NA FULANI MALU PIPU KIDNAP BABA OLUFALAE
Make God save us for Naija o, how persin wan take reason am say na Fulani Malu pipu go kidnap persin wey be Baba Agbalagba wey still get levels like Baba Olufalae. Apart from say he don be presidential candidate before, na still one of the top yoruba leaders plus including say him na one of dem Oga patapata for SDP. Tori yarn us say the fulani don dey get issue with pipu wey dey work for him farm, na so dem go hayaj dem yesterday monday, dey shoot anyhow for him farm wey dey Ondo State, carry cutlass woundjure many pipu, before dem come catch baba, flog am well well, drag am for ground when he no wan follow dem. Now dem don halla the family dey ask for 100m Naira say if dem no pay am before bank close on tuesday...anything fit shele o. Make God help us for dis country. God forbid war.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment