
Monday, September 21, 2015
NA GOD DEY CATCH SARAKI, NOBODY DEY WINSHY AM, PRESIDENCY PARA
Office of we presido don para on Monday say nobody dey winshy we senate presido o on top say he lie for the property wey he polongo. Dem say no Law for we country say make Code of Conduct Bureau wey carry Saraki go court dey collect command from any body. So all the pipu wey dey yarn say na Buhari dey winshy Bukola Saraki no sabi wetin dem dey talk. Tori yarn us say na today Bukola go know howfar cos he don get plenty Lawyers wey dey try see say dem no fall the guy hand. Who win? shey na Buhari abi na Law, na today we suppose know, if dem no change am for us.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment