Monday, September 21, 2015

KERE O! WOLI AGBA FOR INSIDE ALFA SULE SAY MAKE WE DEY EXPECT GBOGBO OGO O!

Ayo Ajewole for inside the Alfa Sule, wey get plenty guy name like Woli Agba, Chukwudi omo Ibadan like dat like dat don say make we all dey expect something tear rubber wey him go soon drop o. According to wetin he polongo for him facebook, e be like say dis one no be drama, na music cos he first hail Baba God and something dey tell me say na wetin he sing for the song wey oyinbo dey call lyrics he write for that hin page. He sha say the title na 'Gbogbo Ogo' come put am for inside bracket say na Woli Agba style proper. Something tell me say na orin emi e go be. Anywhich way we dey wait, I trust am, he no go fall my hand.

No comments: