Saturday, September 19, 2015

MR LATIN FOUNDATION GO DO DEM LECTURE FOR DIS YEAR TOMORROW

For 5 years now Mr. Bolaji Amusam wey everybody sabi as Mr. Latin wey dey do film dey do lecture every year. The number 5 lecture go shele tomorrow 25th September for Obasanjo Presidential Library wey dey Abeokuta and time na 1pm. Title for this year lecture na "No Alternative to Peace" and dem go take am celebrate International Day of Peace ni. Wetin totori mi pass for the mata be say dem go do awoof medical check up plus treatment and the pabambari come be say dem go sama 100 widows beta things to take hold body for the programme. Oga Latin you do well.

No comments: