
Saturday, September 19, 2015
WETIN BABATUNMISE DEY PLAN WEY HE JUST DEY PAINT EVERYWHERE BLUE?
This Babatunmise guy sef, na wa for him. Na only God know wetin he don dey reason again as he just go do one kain design wey dem paint him face blue, come write Yes! on top, shebi Ajimobi don stop Yes O! abi he wan start him own ni? Na so the design come dey show hinself for everywhere you carry your eye on top social media. Na wa for that guy, maybe na show he wan do abi na song he wan release, we no kuku sabi but any which way we go dey observe am like foreing observer. But the guy sabi dress sha, dat one na him oyibo dey call by the way.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment