
Saturday, September 19, 2015
FRESH FM DON STILL CARRY KOMOLAFE OLAIYA PLUS HIM PADI OF LIFE OLALOMI AMOLE
If you dey Ibadan and you no sabi this 2 baba, na him be say you be ope lawawa, you no sabi nothing for radio world. Na wen me sef come ibadan that year, 2005 dem juju catch me for BCOS AM station. Dem programmes no get rival, make I even confess, many jokes wey I take start Stand-up comedy na from dem mouth I hear am, dem funny die and dem be 5&6 from teytey. Na yesterday Fresh Fm polongo am say dem bet don catch dis 2 Ejanla for radio and ne every friday from 2-4pm dem go dey do dem tin on top fresh fm. Dis Fresh Fm sha no wan hear.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment