Monday, September 21, 2015

MAMA H.I.D. AWOLOWO FINALLY GO JOIN HER SWEETHEART AFTER 28 YEARS

One day one day all of us go sha cross the Jordan, maybe e tey abi e near. After 28 years wey her sweetheart cross the bridge, Mama Hannah Idowu Dideolu who be the only woman wey dey officially see Baba Awo finish don kpain. She travel go meet her boo yesterday 19th September at age 99. I no know wetin dey do Azarailu (the Angel of death) wey he no fit get patience make the Mama chop 100 before he take am, as e be say na just 10 weeks pere remain, make the mama Agbalagba see 100. You say wetin kill am? wetin dey kill persin at age 99? Me sef dey ask ni o. RIP MAMA AWO!

No comments: