
Dem say na ojoro, i say shey e no reach make dem do ojoro when dem just dey loose anyhow? Any which way Chelsea sha don collect the 3 points for dem house wen dem flog Arsenal. Arsenal enter the match with 11 pipu, na 9 dem take finish cos 2 of dem players collect red card. Na Zuma plus Hazard be the agbaya wey score against 9 pipu Arsenal. Arsenal fans make una no vex, Chelsea make una continue o, just remember say diarisgod!
No comments:
Post a Comment