Monday, September 21, 2015

E BE LIKE SAY, LAUTECH TEACHING HOSPITAL FOR OSHOGBO DON GET NEW OGA PATAPATA WEY DEM DEY CALL CMD

He no get how, soldier go soldier come. Barrack go everly dey...na so e be for Lautech as tori wey dey enter my hand now dey yarn us say e be like say dem don get new oga wey oyinbo dey call "Chief Medical Director". Him name na Professor AbdulHakeem Olawale Lasisi and he bin dey work for College of Medicine for we U.I. before dem carry am. If na true, we say Congratulobia o, ochara CMD.

No comments: