Sunday, September 13, 2015

LADOJA FANS ENTER THE SAME TROUSER WITH AJIMOBI FANS ON TOP SPLASH FM FACEBOOK PAGE

Shebi na Edmund Obilo cos gbege wen him carry the 2 ogbonge politicians come him programme on radio, no be say dem waka come together o, Ajimobi dey last week, Ladoja dey yesterday Saturday. Na one Olayiwola Saheed Olalekan carry post knack for splash page where he for point the plenty error wey Baba Ladoja do on top the programme and na so the gbege take start o, wey the fans of the 2 baba enter the same trouser dey argue on who better pass who...as I dey type so the mata still dey hot......lwkmd!

No comments: