
Na who Chelsea come offend now o...abi na Mourinho dem dey worry? Shey e fit be say na Baba Olowo, Ibrahimovich offend persin ni? See, na dem sabi. But the koko of the mata be say Everton don still flog dem again today and na 3-1 dem chop like fufu. Wetin make am bad pass be say na one persin score the 3 goals for Everton, him nama na Steven Naismith. Chelsea pipu make una pele o!
No comments:
Post a Comment