Sunday, September 13, 2015
BETTER PIKIN IHEANACHO SCORE ONLY AND WINNING GOAL FOR MANCITY
Who dem be? Dem chop winsh? Na so o, E be like juju, wen dem carry our pikin enter for Premiership game wey shele yesterday when Man City dey play Crystal Palace and he score the only goal for inside the game when referee don dey reason to blow final whistle. Our boy no follow dem start o, dem carry am enter ni make he come do waka pass, as e be like say dem superman, Aguero don woundjure for first half...e never reach 1 minute wey Iheanacho enter wey he show dem say Naija no dey carry last and na him last minute goal make am say dem neva flog Man City dis season.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment