Sunday, September 27, 2015

HURRAY BISHOP OYEDEPO CHOP 61 BYDAY TODAY SEPT 27TH

Dis kain time....years ago, Mama Bishop just dey enter or dey commot from Labour room. For her mind she don born one pikin, she no know say wetin she born na 1 pikin like 1000. The pikin na Bishop David Oyedepo, the Oga Presido for Livingfaith Ministries Worldwide, part of the ministry na Livingfaith Church a.k.a. Winners Chapel. The Man of God no dey take nonsense and him book na ogbonge somtin. Today na him birthday as him dey chop 61 today. We wish Papa Long Life and good health, make we no wish am more prosperity again cos the one wey dey ground him generation wey dem never born no fit chop am finish except say dem be MC Hammer blood.

No comments: