Monday, September 14, 2015

INA LILAHI...DEM DON CONFIRM SAY 6 NAIJA PIKIN KPAIN FOR CRANE ACCIDENT FOR MECCA


Tori wey dey land we dommot, don clear us say 6 of we pikin for Naija wey go hail Baba God for Hajj dis year, don kpain for the crane wey fall on top the mosque. Tori yarn us say 4 of dem na women wey come from Gombe State and the other 2 na men, one of dem come from Kaduna State. Adamu Kargi na hin dem mention him name join the 107 pipu wey kpain for inside the accident. We pray make God give am better rest.

No comments: