One of the youngest comedians wey dey make brain pass for Ibadan and
Naija, Anointed Mallam do him show yesterday for RCCG Jesus Capital wey
dey Oluyole and the show wey dem call Explosive Sunday make brain no be
small. Pipu wan laff die cos all the comedians wey perform for there no
well.
Dr.Frick na him do MC, and pipu wey perform and tear wella na...Mc
Rapindaddy, Arole, 13th Disciple, Peteru, Mc Diouf, Laff Doctor,
G-Jokes, Mc Johnny,Babatunmise, Testifiers, Cymbals plus including plenty other pipu
and walahi all of dem make brains die as koboko no touch anybody.

No comments:
Post a Comment