
Sunday, September 27, 2015
ONE ROAD NO ENTER MARKET, NA HIM MAKE POPULAR DANCER, OREOLUWA OF CYMBALS DEY DO MAKE-UP
Shebi na yoruba proverb talk am say no be one road dey enter market, and bible sef yarn us say na anything our hand fit touch make we do wella. E sure me die say na him make Oreoluwa Adeyemo, who be one of the 3 pipu wey gather dey Cymbals Dance Group dey do make-up. If you no sabi Cymbals na him be say you no sabi ibadan at all cos dem dey rep ibadan die, dem no pass 3 o, but dem dey kill every show like say dem dey with a gun. I don first see her dey do make-up for one of my persin, Sumbo Olanrewaju wen I bin dey Space FM that year, but I just dey reason say na shere shere. But wetin I dey see recently dey make me sabi say the babe no dey play at all, and as she sabi dance na so she sabi make-up. Dex Makeover na him she call am...and I no go lie she dey make my head swell. Oreoluwa a.k.a. Dex Makeover you do well. You siddon for there dey swear for Jona o, say he no give you job...you go tey like taperule...lol
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment