No be small
mata o, na only God know wetin dey happen to Ibadan o, because plenty radio
stations just dey enter anyhow. Na him come make am say the radio stations wey
dey Ibadan now don dey go like 15. Lagelu Fm 96.3 too we hear say don show face
as dem don dey ginger to start for time wey no too tey. Na Splash fm we hear
say still get am, no wonder dem no dey take am easy with dem publicity.
For time wey
no too tey na him Space FM, Beat Fm plus including Star Fm show face for we
backyard but now dem don plenty die. Many don start fully, and some still dey
warm up. Now we fit yarn you say Inspiration FM, Fresh FM, Naija FM all of dem
don start work and very soon Impact Fm too we hear say go start. Make dem dey
come o, no shaking. Abi we dey fear? Ibadan kini so?
No comments:
Post a Comment