Saturday, September 19, 2015

13 YEARS FOR MARRIAGE NO BE BEANS...NA HIM MAKE NOSA IMAGE DEY THANK GOD

One of the fashio designers wey dey make brain for we dommot, Nosakhare Aigbinode wey plenty pipu sabi as NOSA IMAGE climb on top facebook today to yearn the world say Baba God don smile on top him life as per say na today make am 13 years wey him don marry him sweet pretty wife and Baba God don sama dem with beta pikins. 13 years for marriage no be beans, na Godwin. So we say hapi congratulobia to Oga Nosa o. God go keep una together happily forever titi lailai. Wen I see Oga Nosa pinshure for him traditional wedding I get hope say one day me sef go fine. You fit check all him pinshure for him facebook page Nosa Image.

No comments: