We police for Bauchi don catch one 62 years old Agbaya,
Dotti Jumba, wey come from Tumbarja, wey dey Kumbdia District of Gamawa LGA for
Bauch say him pay 40,000 give some bad guys make dem go kpain him daughter
husband, Ahmadu wakili Guji.
According to Police megaphone for the state, Haruna
Mohammed, dem catch am on Friday October 31 around that kain 1pm after him don
hire 4 bad guys make dem go kpain him son-in-law who be 28 years old, who dey
stay for Matamu, in Gamawa LGA. But sha o dem miss the guy and wen dem no see
am na him papa dem kpain instead . But sha o dem don catch the Baba Agbaya plus
including 2 other pipu wey get hand for the matter including the Gonfabi wey be
the middle man.
.jpg)
No comments:
Post a Comment