We Oga patapata for bank for Naija, the central bank don
show face of a new 100 naira note but sha o dis one no be small thing o cos say
na digital and dem no go share vam till December 19th.
The new money wey dem take dey celebrate we country’s 100
year byday na him the Oga Governor for we central bank, Godwin Emefiele introduce
yesterday for the Federal Executive Council Meeting and he even yarn us say dis
one even blind pipu go fit dey sabi am for hand. He say dem do am make he
strong well well cos of naija pipu wey dem hands be like sand paper and the
badt guys wey dey photocopy am.


No comments:
Post a Comment