Wednesday, November 12, 2014

NA GOD SAVE OGA VIGILANTE O, BADT GOYS CHUKE AM BUT HE NO GREE DIE




Na God save Comrade Peter Akporido o, who be the leader of one vigilante group in Igbudu market II, Warri, Delta State, when some badt guys go hayaj am. Tori say him and some of him group members go jam the criminals for Igbudu market and na for there dem start action film o.
Daily Sun hear say seven of the eight bad guys fit escape, Akporido grab one of them and as dem dey struggle, both the Oga vigilante and the bad guy fall enter gutter, and as dem dey struggle dey go, the gun inside the guy pocket fall down but Oga no know say the bad guy still get dagger for him body.


Before he go fit wise up the bad guy don tear him belle and him intestines don dey commot, he sahy him just sharperly use him handkerchief take push back him intestine and quickly halla one Inspector Emen who rushed am go one hospital for Avenue area.

He hail the Assistant Commissioner of Police and Area Commander, Hussaini Rabiu for say he assist am financially and physically, as he quick respond to him condition. Akporido say he still dey own gbese of over N700,000 on top the matter. He come dey beg dem state governor, Gov. Emmanuel Uduaghan and better naija pikins dem say make dem assist am

No comments: