Professor Akasoba Duke-Abiola one of the plenty women of
Chief M.K.O. Abiola, who still dey reason am say she too wan rule Naija for
2015 don carry dem go court o, say dem don dupe am for PDP o, dem don collect
her money for expression of interest and dem no gree let am express o.
She say na dupe o cos she pay and dem give am receipt for 2
million naira for PDP Headquarter. That na why she dey carry dem go court and
even dey carry INEC join sef say make dem no look Uncle Jona face o cos he no
follow wetin law say make he do.

No comments:
Post a Comment