One Oredo Magistrate Court wey dey siddon for Benin o Monday
don say make dem go keep for prison one mama wey get small pikin for hand, Mrs
Obiaka Friday,on top say she pour hot
water wey dem mix with pepper on top her husband.
water wey dem mix with pepper on top her husband.
The mama wey don born three do the bad thing on Nov. 8, 2014, for First Ihogbe
St., Institute of Continuing.Education (ICE) Road for Benin City. According to
NAN, she don dey beg sha o, say she no dey guilty to the one-count charge.
Dem yarn the court say the husband still dey very sick for the
Central Hospital wey dey Benin with plenty injuries. The Chief Magistrate, Mr
Williams Aziegbemhin, adjourned the mata till Nov. 17 say make the Police come
present the facts of dem case.

No comments:
Post a Comment