Friday, November 14, 2014

BABA ADEBOYE SAY NO BE SMALL THING TO BE POLICE FOR NAIJA O, YOU NEED SPECIAL ANOINTIN





Daddy G.O. sef know say no be small things we police for Naija dey suffer o, especially those wey dey work for Lasgidi and that na why dem need special anointing to do dem work o, make dem no go die abi go craze for wetin dem no know.


He yarn that one for him statement yesterday when he go hail the Lagos State command of the Christian Police Fellowship of Naija. He say as we plenty reach for naija, our police need God to help dem do dem work o, or else na craze dem dey take play.

No comments: