Tuesday, April 1, 2014

NA 1,050 FEDERAL CIVIL SERVANTS FOR NAIJA DEY USE FOOTBALL AGE




We VICE-President for Naija, Namadi Sambo don beg civil servants for the country make dem support Federal Government as e dey try to end indiscipline, corruption plus other social vice wey no dey  make we country develop. 


Na for the 60th anniversary for the Nigerian Public Service Commission wey happen for Abuja yesterday Sambo for do the begging. He say make public servants go back to wetin be dem core values, say dem must be more responsive to government and the people for naija especially on top policy formulation and implementations.

For the event, the Oga for Federal Civil Service of the Federation, Alhaji Buka Goni Aji, say dem don arrage how to take retire 1,050 federal civil servants all over the country wey dey use football age, that is wey dey reduce dem age. He say the letters go begin dey fly in the next 3 weeks.

No comments: