THE
National Conference don finally decide the pattern wey dem wan take dey vote,
and na 70 per cent majority na him dem gree say dem go take dey make decisions
for the conference.
Dem
also adopt plan of how dem go take work for the 3-month wey d conference go dey
shelle plus including say dem approve 20
committees wey dem go form under different
categories.
Na Senator Iyorchia Aryu who dey represent former Fenators' Forum na him move the motion
say make dem adopt 70 per cent voting system and na former Governor for Akwa
ibom, Obong Victor Attah,who dey represent Former Governors’ Forum second am.
Na
wen dem resume dem meeting for Abuja on Monday dem adopt all the levelz. We no
go forget say dem cut dem meeting short last week wen delegates no fit conclude
on whether na 66 per cent or 75 per cent majority dem go take dey vote to make
decisions for the conference.

No comments:
Post a Comment