BY ADETUNJI ROTIMI (HAYKAY)
My Pipu, The Pipu's News Council of Elders yan say winch wey dey outside no fit kill person unless say na the winch wey dey inside open door for am. Na so e be wen Crystal Palace and
Chelsea meet last weekend and na John Terry be the wicsh
wey open door for them enemy,
cos na him score the goal and he almost woundjure
dem keeper Peter Czech for the mata if to say if Czech try catch the poss the
one wey he do, he fit carry 3 season injury cos d placing wey terry give am no
be here.
Na so Crystal Palace take chop bonanza win wey be "ESCOBAR", una remember? . Na 1-0 in favour of Crystal Palace.

No comments:
Post a Comment