This one no fit be help from above o, and
e be like say time don reach for government to come supply answers cos naija
pipu don dey ask plenty questions. As per say all the elders for Borno and Yobe
states dey para say dem dey see helicopter wey dey come drop gun, bomb, food
plus including medicine to areas wey pipu know say na there dem boko boys take
dey do dem kingdom for North-East.
Dem say with wetin dey on ground dem
State authorities no fit form say dem no know say that kain thing dey happen
and say na bad sign o if like 20 to 30 Toyota Hilux jeeps fit dey move together
once, from one place to another and no body go see dem challo, wen dem no be
soldier ant, say the mata no gree let person reason am o say dis kain thing fit
dey happen even as per say heavy curfew dey for the area.
The elderlies who yarn for one press
conference for Abuja on Monday, come
even ask government make e yarn dem how boko boys fit go hayaj Maiduguri
Air Force Base and dem light plane plus including other military facilities for
fire even on to say state of emergency dey and curfew thick for town like gari
smoke.
Wen dem dey yarn under the umbrella of Borno,
Yobe People’s Forum, the elderlies also yarn authorities say make dem yarn Naija
pipu who commot security pipu from the Federal Government College, Buni Yadi, just
some few hours before dem boko boys go attack the school and kill 59 innocent
children for there.
Na one former Chief of Air Staff, Air
Vice Marshall Al-amin Dagash (retd.), na him yarn as megaphone for the press
conference.

No comments:
Post a Comment