The Defence Headquarters don loud am o
say dem don start one serious gbege to take fight bandits wey dey cause gobe
for the three states wey dey North-Central, Benue, Nasarawa and Plateau.
The Oga Director for Defence
Information, Maj.-Gen. Chris Olukolade, na him yarn this mata for one e-mail wey
he send on Monday say the DHQ don send troops wey go burst the whole kasala and
show the bad guys pepper go the three states where dem don kpain plenty pipu
and destroy plenty communities for the gbege wey dey shele between Fulani malu-pipu
and farmers.
Olukolade yarn say the Nigerian Air
Force, police plus including other security agencies don also send dem own pipu
for the mata o to make sure say dem restore peace to the 3 states. He said dem
assignment na to go find the criminals and make dem take over, collect power
from the bad pipus dem.

No comments:
Post a Comment