Tuesday, April 1, 2014

WE GO PUNISH UNA COS UNA FALL OUR HAND-DEM SSS OGA



Dem Oga for the State Security Service don start investigation o, wey dem wan take shine light for the prison break wey bin wan shelle for dem detention facility wey dey Abuja on Sunday.


Punch correspondents hear on Monday say the investigation na to punish dem officers wey fumble and mis-do for the mata, who be say na dem carelessness cause the mata.

Dem yarn on Monday say dem don re catch 16 of the prisoners wey bin escape for the prison break and . Dem say dem oga for SSS no happy at all o, say this kain yeye thing fit happen o and say dem officers fit gawk am like dat. Dem say na since Sunday dem don start dey probe the mata.

No comments: