Thursday, March 6, 2014

UDUAGHAN RESPECT YOURSELF NO DEY TRY BUY OUR MEMBERS AGAIN- DELTA OGA FOR APC


The interim Oga for APC in Delta State, Prophet Jones Erhue don vex talk am say Oga Governor for the State. Emmanuel Uduaghan dey take plenty millions buy dem APC members to PDP for Delta State, na wen him dey gist with news pipu he talk the matter on Tuesday.
 

The Prophet wey don turn politician say wetin dey pain am and dey surprise am pass na one useless talk wey Oga Governor talk recently say na PDP be the only party wey dey Delta State, so he come shock now say why the same Governor go come dey carry money up and down to buy dem own members. The Prophet talk am say before him join APC na PDP him for dey run him package  and him know how the election ojoro dey be that year, but den na APC win many of the chair wey dey them house of Assembly in Delta, but say as he dey talk on that Tuesday, PDP don buy many of dem say na only one Hon. Benjamin Okiemute Essien dem never get the correct price to take buy wey still dey APC for the house, he say as PDP dey try bargain reach with Hon. Essien the man no dey gree port to PDP, say no mata wetin dem do Hon. Essien no go port like Saka, newspaper pipu wey dey there say na with vexnation the prophet dey talk o.

He say dem don catch some olofofo and bad belle pipu for inside dem party wey PDP buy come send to dem party make dem come cause katakata for inside APC, he say some of those kain pipu even dey talk am say dem wan contest become Governor for the state and na dat one them take dey get many many nonsense group wey dey work for them. He say as per say him be Prophet na God hint am the pipu wey wan come scatter dem party. Say so make members shine dem eyes o, make dem dey careful of those wey dey claim say na dem be the original party Oga for the State.

The prophet no stop there he take time use him mouth run down all the project wey the Governor dey do for the State, he say na to the dualize road dey sweet am, say other better things e no do and the litu ones wey he come do half way, he go take papparazi kill am, put am on top TV, newspaper and internet, he say if the Governor wam learn how dem dey do better project make he go Edo State, Rivers State and Lagos State make dem give am better lecture. The prophet dey vex o, Uduaghan be careful o.

No comments: