Thursday, March 6, 2014

ABEG TELL US THE KOKO OF WETIN DEY HIDE PETROL O, ABI UNA DEY DRINK AM? APC RAKE FOR PREESIDENCY



Alhaji Lai Mohammed, wey be the megaphone for APC don yarn again on Wednesday o, say make Federal Government stop to dey maga us for this country dey tell us say na panick buying dey make petrol scarce. He say make dem come out come confess say the money wey dey miss don dey take style affect us.


According to him the kain long line wey dey petrol stations dis day na die and na juju combine with prayer and fasting people take dey see fuel buy now, he say while Naija pipu dey suffer for the crime wey dem no commit, those wey thief the money, plus including the subsidy own still dey street dey blow guy, dey do anyhow and nobody touch dem. He come tell Federal Government to dem face say dem lie pass devil as dem dey always promise say na so so so dem go do to make life better for us, where as dem no dey do dem, now na Naija pipu dey suffer as dem no get petrol to take on their "I better pass my neighbour" generator and na so heat wan finish dem. To come kuku make the mata spoil finish dem no fit commot for house cos transport money don double.

He say finally the Federal Government don fall dem hand finish cos na this fuel mata dem first take dey boast say na dem get power to do am make petrol no dey commot for ground but as the mata come be now, dem no get any levels again. So make Naija pipu dey shine dem eyes dey expect more scarcity.

That one bad o.  
  

No comments: