A.K. AFOUDA SAMUEL
Police for kano don come out to talk on Monday say na lie
den dey lie for dem head o, den no touch any bomb for Audu Bako Secretariat for
inside Kano o, as per say bomb no be toy na. ASP Magaji Majiya wey be police
tatafo for kano na hin talk am say na some bad belle people wey won make people
dey fear for the State dey carry dat kain yeye rumour.
He even remind us say make we no forget say na so den still
carry the fake gist last week say bomb don blow for Dangi Rounabout, Zoo Road,
den even carry old pictures of bomb wey don die since 2012 on top facebook dey
lie and deceive people say na now the thing dey blow. He sha come tell the
people say make dem relax dey do normal say there is no cause for alarm.
Accoring to NAN tatafo, some people no gree wait
make office close on Monday before dem run go their house go hide dem head. You
blame dem, if na you nko?
No comments:
Post a Comment