Tuesday, March 4, 2014

OGA POLICE RAKE FOR POLITICAL PARTIES: NO TRY REASON AM SAY YOU WAN PASTE POSTER OR DO RALLY FOR SOKOTO O



Oga for police in Sokoto, Mr. Shuaibu Gambo, don prove leVels say him na correct police man and him no dey shake as he try talk sense into political leaders for the state. Na on Monday he gather them and start to dey lecture dem like say dem be primary school pikin. 

 
He say the talk and meeting dey necessary so dem go fit make sure say katakata and kasala no dey dem area, and that na why he dey try clear dem say police no come play ludo for the State o, den get wetin den suppose do and that na to make sure say any body wey no couple abi anybody wey dey do anyhow, see anyhow. He come even get mind talk am say as political parties plenty reach for sokoto State na only two of them (wey we all know)  they do anyhow, dey flex muscle and dey show themselves.

After Gambo don clear dem doubt on him duties and responsibilities, he come advice dem say if politics no dey gree dem do, make dem find better things do with their life, as politics no be do or die affair, so make dem stop to dey hire thugs like say na war dem wan fight.

As e come be say where law no dey, crime no fit dey and make e for no lost na him the Police Commissioner warn dem say make dem just dey do their meetings dey go o, make dem no reason am say dem wan do campaign, rally or paste poster for election anywhere fro Sokoto state until 3 months before election. Make we sit down dey look if den go fit.

No comments: