The Commitee for Sport in our House of Representative don
dey vex since den show us the kain jersey wey Super eagles go cack for the
World Cup wey dem go play this year. The Oga for the Committee, Mr. Godfrey Ali
Gaiya wey talk for him pipu say na which kain yeye green dem come give us so
like say we no pay dem complete money.
He say na that kain green wey dey on top our national flag den suppose use, say dis one wey den use no be our own at all.
He say na that kain green wey dey on top our national flag den suppose use, say dis one wey den use no be our own at all.
Buy u fit come dey wonder say why Oga dey vex on top ordinary colour like this, the mata no be clear eyes o, as e be like say wetin make Oga dey vex na say the kain colour wey the tailour use for our jersey come look like that of glo, the telephone people wey dey among sponsors for Super Eagles. And you know say before that kain thing go happen for Naija, dem for don Roger some people. Oga sha talk say den go find out o, maybe na glo put hand for the mata abi na the tailour no just sabi colour
No comments:
Post a Comment