Monday, March 3, 2014

BABA GOD GENTLE SHA O : ROBBERS ENTER CHURCH DURING SERVICE FOR IBADAN



E be like war film yesterday when some bad boys form Rambo and Commando enter vine Branch church wey  dey Queen Elizabeth Road, mokola for Ibadan with the bad mind say make den delete the church thites and offering.


According to the gist wey we hear, the bad boys gather enter church join normal people before den try hayaj the banker wey den think say carry God money, but Baba God himself don move him money before den fit do anyhow. Na when the robbers come finally realize say den don jonze den vex start to dey shoot anyhow wey cause katakata for inside the church auditorium.

But big salute to our police for naija as den too show themselves small, den try fall one of the robbers but him guys still manage carry am follow body, but two of the policemen wey dey on duty no dey lucky cos wen the robbers fire the police van wey dey outside the church, bullet touch two of the three police men and na there den die. But God save one of them as him own odeshi get mind work for inside church compound. The boys try say make den cover their y**sh as den make moves to scatter all the machine wey monitor the action. The police PRO of Oyo State, DSP Olabisi Ilobanafor, confirm am say 2 of dem guys for police fall for the mata.

No comments: