Former governor of Enugu State, Senator Dr. Chimaroke Nnamani
don take style run go back to PDP where he for run commot some four years ago,
when things no dey rosy that year. Na that time he go gather one kain political
party Peoples Democratic change (PDC) where he for try hustle the senatorial seat
for Enugu East that year.
The ebe ano Governor say as a 100 percent Nkanu man, na
volunteer him dey volunteer himself to represent his people……………….(I
laff in urhobo, I go volunteer too o)……….., like the prodigal son, na
big party den take welcome am back to the party after he don register with the
party on January 4th, 2014 for him ward Nkanu West Local Government,
Enugu. When the party chairman wey lead the dance troop wey go welcome am, Mr.
Monday Ngene, dey yarn he say na big boost the retun of Nnamani be for them and
their party say the guy bin don try wella for the State.
As bros dey yarn with the people wey go welcome am, he try
tototri dem small when he say make den dey shine their eyes well well as per
say den too get power and person never flog them before, so if den no get
person wey sharp enough to lead dem hin don volunteer himself to go represent
dem for the senate (place wey billions dey flow, why not for a book haram state),
in that case he come ginger dem say make den no gree for person wey no get Nkanu
blood to go show face for dem in the senate.
No comments:
Post a Comment