APC yesterday vex talk am say God forbid, how dem go copy PDP
manifesto, say shey e possible make person copy empty something? Na the interim
National Publicity Sectretary, Alhaji Lai Mohammed talk the matter yesterday. He
say the poll wey KA Research Limited, dem Africa division do where dem party (APC)
for dey lead PDP with 10 percent na the original somtin say that other one, the
NOI polls na PDP do am for demself and by demself cos na Aunty Ngozi Okonjo
Iweala be like say do the thing.
Alhaji Lai Mohammed dey try clear the mata before dem launch
dem ROADMAP wey dem go do for Abuja tomorrow, he come take him time talk plenty
on top how Naija people dey talk am that time say na make parties marry o, how
dem come take decide say make all the parties marry, how dem take marry and how
dem take select Alhaji Audu Ogbeh make he head the manifesto committee (now e
be like say I don know where the similarity for come, cos he be like say chief
Audu Ogbeh na former PDP chairman o).
He talk say everything wey dem do na him dem make sure say
he dey standard according to wetin INEC ask and on top say dem dey find members
like winsh wey PDP chairman talk for PDP rally for Ilorin on Monday, he say all
those na proper lie o, say na dem PDP dey suffer lack of member o, no be dem cos
dem get mouth for West, North, East and even South South, so make PDP no just
talk am come out o.
No comments:
Post a Comment