No be joke o, since yesterday Naija youths don reralize say
e be like say na punishment for the 20billion dollars wey we dey ask for dey
cause this petrol scarcity. Because if we follow wetin dey happen wella and
with a open mind we go realize say according to the letter wey Reno Omokiri
a.k.a. Wendell Simlin write, this kain thing dey happen to carry our mind
commot from money matter.
Now wey Bro Reno don open our eyes we don realize say this
scarcity na that kain distraction thing. So because say we no fit fuel car or generator,
businesses no dey move, people don dey house arrest as transport money don
mega, na him ouths dey beg NNPC on facebook, twitter, bbm and for other social say if we ask for that 20 billion dollars again
make dem arrest us. I hear say for Calabar na like 250 naira per liter and those
wey dey sell black market dey see the thing sell, where dem for dey see am we
no know, the only song wey NNPC dey sing since na “panick buying”, but this
matter don dey pass all that grammar o.
The koko now and all wetin we need now
na petrol, afterall if dem find the 20 billion dollars no be say dem go share
am for us or den go take am do anything for us, na some people go still chop am
too.
Abeg tell me if fuel dey your own area and na how much make I
come buy.
No comments:
Post a Comment