Our Presido, Bros J don show am on Monday say he no dey
slow down at all on top the conference matter as he drop note wey he take
announce dem Ogas wey go run things for the national conference.
According to the note wey he drop through Federal
Government secretary, Oga Anyim Pius Anyim for Abuja on Monday, na former
former people, he take head the matter; the Chairman na former Oga patapata for
Judiciary, Honourable Justice Legbo Kutigi, the vice Chairman na another former
man, former minister for foreign affairs, Prof. Bolaji Akinyemi. The mata no end
there as Dr. Valerie Azinge go be the secretary on top the mata. Abeg Bros J,
if una go need treasurer for the mata, halla me make I forward my CV.
No comments:
Post a Comment