Na yesterday Monday, Oga Governor for Rivers State, Mr.
Rotimi Amaechi vex scatter federal government career with him mouth wen he dey
inside wrestling ring, sorry….Rivers State House of Assembly, where he for dey
gist dem on as the matter dey go for Naija.
The guy say he no fit just understand the kain yeye party
wey our federal Government dey do wen book boys just delete like 40 innocent
Nigerian children for the North. He even notice am say Abuja people wey suppose
be aso ebi people for the parry self no get chance take show face for the parry
as many of dem dey where den dey hide dem head fro armed robbers and assassin and
some of them dey on top line for petrol stations.
He say Federal Government no just try as den dey lie give
Nigerians say no lele, nothing dey happen but sha o he still clear dem say dem
no dey tell blind man say rain dey fall as Nigerians dey feel am for body say
dat na why dem don tire to dey celebrate anything. Make he no be like say he just
yarn, he ask dem questions before he commot, say where naija go dey in the next
100 years? Na which kain legacy we wan give the generation wey dey come behind
us? Shey na candle lite abi I better pass my neighbor generator we wan take
build that kain oyinbo economy?
No comments:
Post a Comment