This
one na wa o, like 32 pipu wey dey think say dem don escape death for the surutu
wey Fulani pipu dey cause for some areas for Benue State na him report say dem
don finally go die for the camp wey dem dey rest dem head near Bank area for
Makurdi town.
Saturday
Vanguard’s investigation show say children and old pipu wey run from the gobe
na dem don dey expose to some kain bad conditions for the camp, wey many of the
pipu arrange for demselves.
Investigations
still show am say yanmayanma disease wey like to dey chop small small pikin
like measles, diarrhea and malaria don follow dem dey stay for the
camp, and apart from that sef many of the pikins no dey chop better food.

No comments:
Post a Comment