Thursday, March 6, 2014

SACK LETTERS STILL DEY FLY FOR ABUJA O, DIS TIME NA FOR SPORT MINISTER HAND E LAND.


Oga presido for we country Bros J on Wednesday show am say he never do finish with the sack letter wey he dey share o. This time around na the ministry of sport he send the letter and the thing land for the hand of Oga minister, Bolaji Abdulahi, 
 
(since the gist enter town, country people don dey wonder why because many of dem believe say the man na one of the best ministers for Bros J cabinet, at least him head don bring us 2 trophies and qualify us for world cup, but many dey think am say na the former minister no play him card well as he no dey Kwara wen Bros J go welcome dem new members to PDP, pipu come dey think am say e be like say Bros J don dey smell APC for the guy body). Presido talk the matter for Council chamber wey dey Aso Rock yesterday wen he dey swear for………sorry swear in 11 new ministers and dey carry work give dem.

Bros J ask dem new ministers say make dem resume work immediately as den just remain on their sit for the Federal Executive Council meeting wey dey always hold every Wednesday. Bros J clear dem new minister say if dem think say dem go fit do anyhow, him go make dem see anyhow. He say make dem use dem office to make Naija better and make dem dey try use dem brain take do new and better things wey go make him administration get good name. he still advice dem make dem dey befriend each other so everything go pure.

Make I sha tell u the name and position wey him give dem new ministers; Sen. Misiliu Obanikoro of Lagos (kosi koro kosibo), Minister of Defence State, Alhaji Mohammed Wakil (Borno) Minister of State Power, Alhaji Abdul Jelili Adesiyan (Osun) Minister of Police Affairs (person wey dey cry wen dem say he kill Bola Ige………..well sha he reach make person cry), Aminu wali (Kano) Minister of Foreign Affairs, Mrs. Akon Eyakenyi (Akwa Ibom) Minister for Land, Housing and Urban Development, Mrs Lawrencia Laraba-Mallam (Kaduna) Minister for Environment, Dr. Tamuno Danagog (Rivers) Minister of Sports, Hajia Asabe Ahmed (Niger) Minister of State Agriculture, Gen. Aliyu Gusau (Zamfara) Minister of Defence, Boni Haruna (Adamawa) Minister of Youth Development,and Dr. Khaliru Alhassan (Sokoto) Minister of State Health.
Bros J for make am 12 o, make we get Minister for Boko Haram Affairs. Na lie?   

No comments: