Thursday, March 6, 2014

ABACHA FAMILY DON VEX FOR SOYINKA O, BUT THANK GOD SAY DEM NO DEY RULE



If to say Abacha family still get that kain power ni, we for don dey sing Jim Reeves across the Bridge for Baba Professor Wole Soyinka, cos the way the family dey vex for am no be here.
Na two children of the badoo himself (I mean Abacha not Olamide) write letter to show dem vexnation for the white hair baba wey sabi book pass library. 
 
Gumsu Sani Abacha, the daughter even talk on top twitter say she bin like to read Baba Soyinka book wen she be pikin but the word wey commot from the Baba mouth concerning her papa na mumu and oponu talk wey no make sense at all.

Wetin dey pepper her body na wetin Baba Soyinka talk say him no go fit collect that kain yeye award wey Uncle Jona dey share for Abuja to take celebrate say our country don old reach 100 years because say dem put Abacha join the people wey dem wan dash the award. He say the give wey dem dey give Abacha na like say dem dey call all of us for Naija mumu.

Make e for no loss, the badoo son, Sodiq Abacha too talk him own o. but na long letter like that wey Bro Paul dey write for inside bible the guy write. He talk big big grammar wey make some people dey suspect say na person write the letter for am cos dem no believe say him brain go fit carry that kain vocabulary.   The guy say since him too be pikin na him he don know say Professor Soyinka dey take him mouth run down every government, say if him too sabi why he no kuku carry box make we vote for am as presido for Naija. He come even remind Prof say that time wey IBB bin make am FRSC chairman say shey money no loss. He also do well to remind Prof. say no be him papa kill MKO Abiola o, as Prof talk am for him own letter, cos person wey don die no fit kill person wey dey alive o as per say him papa die before MKO. He finally talk am say Soyinka don already fall him hand so make he just sit down jejely and maintain him champion for him side.