Our
Presido, Bros J don take vexnation halla dem Oga for Immigration say make dem
come yarn am as the thing go for the yeye examination wey be like world cup wey
dem arrange last Saturday.
We hear say na like 18 pipu kpef for the mata for different areas for Naija on top say dem wan join Nigerian Immigration, but the koko be say dem wey arrange the mata no try at all, na him make pipu dey push, dey jump on top one another come even make dem Oga police dey shoot for some area. The end of the tory be say na like 18 country pipu fall for the mata.
So Oga Moro, who be the minister for interior wey dey control Immigrartion and the Oga comptroller General, David Parradang na 2 of dem Presido halla make dem come tell am how the mata be cos pipu don dey vex talk am say make den sack dem. But when dem go do meeting with Bros J yesterday none of dem gree talk come out wetin dem discuss for inside the meeting.
whether dem tell us or dem no tell us, time go yarn us wetin dey happen.
No comments:
Post a Comment