Alhaji Aliko Dangote my distance Uncle don vex finally as he
don climb to the top of the ladder, break, make and re-make history as na him
go be the first black man wey go dey among the top 25 people wey get money pass
for this world.
While some people dey house dey analyze Amaechi mata, dey
laff my Oga at the top, dey curse dem mama on top Linda Ikeji blog, my Uncle Dangote
softly dey increase him money from 16.1 billion dollars to 25 billion dollars
and him jump from number 46 on top the top 100 billionaire list wey him dey
last year to number 23 this year, the guy half him position.
Glo chairman, my……maternal step Uncle na the next Naija man
on top the list for number 325 with 4.6 billion dollars and my god mother Mrs. Folorunso
Alakija the executive Vice Chairman of Famfa Oil na the richest black woman for
this world. She dey number 687 with 2.5billion dollars, (Abeg who be come be
the executive chairman, if she na executive Vice Chairman).
Meanwhile my Oyinbo roles models, Bill Gate don return as the world
number 1. Before you start to dey gossip again today abeg ask your self which
number you dey on top this list……………lol
2 comments:
Who no like better thing.....ole!
I no know say u all these big people nah ur relative o. U sef go soon reach be that. E go better. Myopinion.
Post a Comment