Miss Simplicity - Afta tori nack media sey sum pipu kpai for Nice wey dey France, our ogbonge nd legendary actress Genevieve Nnaji enta her IG page go show sympathy for d pipu wey kpain for dia o, she post France flag nd she write on top ham sey make pipu pray for France o bt her fans no hapi bcos of her post o nd dem para, dem tear scatter scatter for her like sey tomorrow no dey o..
Sum tok sey na naija need prayer pas o, sum com tok sey we no need pray for France o base on sey white pipu sef no dey pray for Nigerians o nd sum even tok sey Genevieve fall their hand no be small...
Hmmm, God bless Naija...
Oya make una sharperly see hw d tin take go, d tin wey Genevieve post nd d way pipu tear for ham afta d cut..
Friday, July 15, 2016
SEE WETIN MAKE GENEVIEVE NNAJI FANS ASK HER SEY: NA WHO FRANCE HELP???
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment